Latest election results in Zambia: President Edgar Lungu reject election results

LUSAKA, 15 August 2021, (TON): Zambia President Edgar Lungu don release statement wia im tok say di general election no dey free and fair.

President Lungu claim say dem chase party agents of di governing Patriotic Front from polling stations and therefore dem no fit protect dia votes.

Im allege say serious violence happen for three provinces wia im party lose votes.

Early results from Zambia put opposition leader Hakainde Hichilema for di lead

How di winner of Zambia election go emerge.

Oga Lungu also allege say di killing of Patriotic Front chariman for di north western province on di day of di elections render di elections not free and fair.

Anxiety levels dey extremely high for Zambia as pipo don dey patiently wait to find out who their next president go be.

Di electoral commission dey slowly announce election results as dem dey come in following Thursday elections wey dey declared to be relatively peaceful by African and European observer missions.

But di incumbent President Edgar Lungu wey dey behind di opposition for di votes wey dem don count so far say three provinces wia im party lose votes bin dey characterized by violence and im claim say make dem cancel di elections.

President Edgar Lungu dey look for second term and Hakainde Hichilema na di main opposition candidate.

Meanwhile opposition leader Hakainde Hichilema accuse di incumbent of trying to throw out di electoral process as part of effort to hold onto power.

Early results from Zambia presidential election show say na di opposition candidate, Hakainde Hichilema, dey lead over di incumbent Edgar Lungu, according to di first results from di electoral commission early.

Rate this item
(0 votes)
Login to post comments
Go to top